My peoples,
Make una read this list o. E don reach time wey we, as origina Niaja
peoples go stop to dey use abreviations like LoL, LMAO, LMAOROTF, BRB,
WAS, etc etc. When we fit dey use abreviation for our own exceptional
street lingua.
why?
1. ur at work and ur chattin, no amount of spyware and things go bother
you, u go still fit yab ur boss NS(nothin spoil) whilst u still dey
answer the mugu YB (Yes Boss).
2. Since our slangs are non-tribal, who knows, maybe this will furthher
foister the bond one a ONE NAIJA...especially since its written and thus
there's no chance of Danjuma pronouncing anything hillariously.
3. Hey, why not, I'm sure it'll be fun learnin and more fun
indoctrinating others too.NLT (I shant translate this). As my brother
Prince would say; Is a hell of Lingua.
So peoples, LGT!
1. LWKM - Laugh wan kill me
2. LWKMD - Laugh wan kill me die
3. MIDG - make i dey go
4. WGYL - we go yarn later
5. IGA - I gbadun am
6. ICS - I can't shout
7. DJM - Don't jealous me
8. WBDM - Who born d maga
9. UDC - U de craze
10. NUS - Na u sabi
11. WSU - who send u
12. OSABZ - over sabi
13. ITK - I too know
14. WDH - wetin dey happen
15. NDH - nutin dey happen
16. FMJ - free me jo
17. BBP - bad bele people
18. HUD - how u dey
19. WKP - waka pass
20. BBG - baby girl
21. KKL - Kokolette
22. MML - mamalette
23 GFF- Gbono fe le fe le (e.g., she GFF)
24. NTT - Na true talk
25. IKU - It koncain u?
26. NDM - no dull me
27. LGT - let's goo there
28. IFSA - I for slap am
29. IGDO - I go die o
30. YB - Yess boss
31. NLT - No long thing
32. 2GB - 2 gbaski (e.g., the song 2GB!)
33. CWJ - carry waka jorh
34. WBYO - wetin be your own
35. U2D - U 2 do
36. U2DV - U 2 dey vex
37. MKG - maka gini?
38. WSDP - who send dem papa
39. INS - i no send
40. INFS - i no fit shout
41. WWY - who wan yarn
42. NBST - no be small thing
43. NWO - na wah oooooo
44. NMA - no mind am
45. MIHW - make i hear word
46. NBL - no be lie
47. NB? - na beans?
48 wd - wetin dey
49. UNGKM - u no go kill me
50. o2s - omo 2 sexy